DON'T LET THEM!
Dem call the babe Orobo
Dem say na why she no get any Bobo
Dem call the babe Orobo
Dem say na why she no get any Bobo
She lock herself all day inside her room
E be like say the floor never even see broom
Na drag she dey drag herself waka for street
For suya joint she go land to price meat
Wetin dey her body na human flesh no be cow
But the young rappers dey carry her do street show
At 30 she was displayed for win
Her papa no wan loose her as he lost her twin
Dem wake up one morning see her fat body for ground
She been drink some concor to loose 50 pounds
"Marry my daughter and I'll give you cars and houses
"Enugu boys line up like chariots and horses
Even some big boys go hide their pride
Four hours don pass and nobody see the bride
Orobo stand for for bridge wan do like her sister
She no go fit continue to bear this shame any further
Even dem men just wan marry her for her father money
How she go kill the bee come enjoy the honey
She change mind waka enter one cathedral
She see different children wey dey play with anunty Sandra
Aunty Sandra begin share gifts and smile from her iron chair
As Orobo look well the iron chair don turn to wheel chair
As she said "Hi" aunty Sandra come smile and wave her hand
She go near as aunty Sandra give her her card
Written on it was "I can hear you slightly but I can't speak"
Orobo no believe and she no even fit think!
Beautiful and handicapped Sandra making impact
"How did you manage to follow this path"?
"I have a friend who is always there when the world despised me"
"He is a friend who sees me beyond what the world can see"
Orobo knelt down and asked Jesus into her life
From that day helps-ministry became her sole drive
Helping others go through loneliness and stigmatization
She used daddy's wedding prize to open a foundation
Dem dey call her sisi Orobo
Because na for TV dem dey see her with Oyibo
"Don't let people let you down when you should be up"
Now Na Ministers of God line up to hook up!!!
Ota Uma Uma Benjamin
31/10/2013
(c) 2013

Great! Inspiring! welldone Uma.
ReplyDeleteEncouraging
ReplyDelete